One group wey dey call dem Arise Ghana togeda wit some religious groups don hit di streets to protest against di delay by di supreme court to deliver judgement on di injunction application against di anti-lgbtq bill. Di group bin bash di chief justice Gertrude Torkonoo say im and di attorney general dey drag dia feet for di mata for di Supreme Court. Two pipo – one human rights advocate and anoda journalist carry di mata go di Supreme Court say di ‘proper human sexual and family values bill’ wey be popularly called anti-LGBTQ bill, dey unconstitutional.