“For same-sex marriage to dey legal for Ghana, e no go happun for my time as president” Akufo-Addo tok dis during di installation of di Second Archbishop of di Anglican Church of Ghana for St Micheals and All Angel’s Cathedral for Asante Mampong. “I tok am before, and make I stress am again, e no go be under de Presidency of Nana Addo Dankwah Akufo-Addo wey same-sex marriage go dey legal”. Di President tok dey come as pressure dey on im goment to come clear and state dia position on activities of pipo wey identify as Lesbian, Gay, Bisexual, Transgender and Queer. (LGBTQ+) for di kontri.